First Half
12′ Referee Peter Kamaku points to di corner flag and DR Congo gopl ay corner.
12′ Theo Bongonda of DR Congo fire dia first shot from di edge of di box, but Morocco defender block im effort.
10’Achraf Hakimi of Morocco play di throw-in sharp sharp so dat im teammates fit outnumber di defenders for di penalty box.
7′ GOAL! Achraf Hakimi of Morocco controls di ball from di corner kick and put am past di helpless goalkeeper.
4′ Morocco get corner kick.
2′ Early goal attempt from Morocco as Ziyech give pass to En-Nesyri wey head di ball toward di top post. Lionel Mpasi-Nzau show im brilliant reflexes and pulls off a glorious save to stop di ball from hitting di net.
1′ Referee Peter Kamaku from Kenya don blow whistle, match don start.
Both teams don file out for dia National anthems, match go soon start.
Morocco and DR Congo go face each oda for dia second group game for di 2023 Africa Cup of Nations (Afcon).
Di match go happun for di San Pedro Stadium on Sunday and di Atlas Lions dey also hope to seal dia qualification for di next round.
Morocco na di only Group F team wey win dia first game – dem beat Tanzania 3-0 and dem dey confident as dem dey enta today match wit all three points.
Meanwhile, DR Congo dey hope to surprise one of di biggest teams for Africa, and fans dey wonder if dem fit upset Morocco for dis match.
DR Congo manage get only one win for dia last eight matches.
Line ups
Morocco starting XI: Yasine Bounou, Achraf Hakimi, Sofyan Amrabat, Nayef Aguerd, Ghanem Saiss, Hakim Ziyach, Azz-Eddine Ounahi, Selim Amallah,Youssef En-Nesyri, Sofiane Boufal, Mohamed Chibi
DR Congo starting XI: Lionel Mpasi, Henock Inonga, Samuel Moutoussamy, Theo Bongonda, Gael Kakuta, Cedric Bakambu, Charles Pickel, Yoane Wissa, Chancel Mbemba, Gedeon Kalulu, Fuka Masuaku
End of Twitter post
Crédit: Lien source
Les commentaires sont fermés.